As I dey live my life dey go so...
I dey learn plenty things...
Some of dem be say:
Every situation no be watin we think say e'be...
(e good to reason well before we decide)
No be every 'thin' be sickness...
(sometimes we dey shed things 'toxins' wey we no need comot)
No be every 'fat' be healthy...(some things just dey swell)
No be every 'lowly' position be say "dem don tie you"...
(sometimes nah there we supposed dey at dat time...so that we go learn)
No be every 'high' position be 'say you don hammar'...
(sometimes nah watin Oyibo call "the more you look the less you see...wash-wash")
People go enter, come commot for your life
(nah their time to enter and commot be dat)
Sometimes you go dey wonder whether nah so your life go take end, because all the things wey you bin expect to happen at certain times 'never' happen
(my person...no be only you dey feel that way sometimes)
So tey some go begin paint some kain 'picture' for the world...make dem for feel better...
(no need for dat...make you just shed some things/people wey dey put you for that kain pressure comot)
Dat thing wey dey make you happy...
(make you dey do more of dem)
Make you no fear say nah 'only you wan do...or stand for something' wey you believe say nah watin God want make you do...
(no follow crowd waka go enter ......no-where, you no be sheep)
The moment wey you decide, come take the first waka...to do the thing wey 'Right' (before God)...nah so the 'Right' doors dem go dey open.
Make una jolly for this weekend, make me sef go find watin I wan do today...
We go yan later.